Big Brother Naija 2021 housemates: Africa Magic reveal BBNaija shine ya eye housemates

 

Nigeria biggest reality show Big Brother Naija don announce audition date for season 6

WIA DIS FOTO COME FROM,BIG BROTHER NAIJA

Di 2021 edition of di biggest reality TV show for Nigeria, Big Brother Nigeria don officially start.

According to di show host Ebuka Obi-Uchendu di show go last for 10 weeks.

BBNaija na di biggest reality show for Africa, ova 49 kontries for di continent tune in to watch di season launch wey start by 7pm West African time, according to di show organizers.

Dis season get two launch shows. Di first launch happun on Saturday 24 July, di second go be on Sunday 25 July. Di launch show go start by 7pm West African time. 

Keep Refreshing as we Update the list

Who be di housemates?

Boma

Boma

Boma


Im be 34-years-old mixologist wey also don do some modelling and be former footballer.



Okusaga

Okusaga

Saga


Dis 28-years-old engineer come from Lagos State. Okusaga aka Saga say im go "bring vibe to di house".

Yousef.

Yousef

Yousef

Dis bi-racial Nigerian be teacher come from Jos, Plateau State and plan to bring lots of entertainment for di show.

Im sey e go like make pipo dey call am Yousef

Pere.

Pere

Pere

Drama and gbas-gbos, na one of di housemates wey Ebuka announce as housmeate on di show.

Pere say im be actor and plan to "bring spontaneity to di audience on di show.

Whitemoney.

Whitemoney

Whitemoney


Im say e be businessman wey dey into shoes.

Niyi.

Niyi

Niyi

Dis former basketballer come from Oyo State and e don marry wit one pikin.

Im also be businessman wey dey run fantasy game platform and event business for Cape Town, South Africa.

Yerins

Yerins

Yerins

Im be medical doctor wey say "e like to eat even though e no dey show for im body".

E describe imsef as 'polymath' wey get undying love for many creative things.


Jay Paul.

Jay Paul

Jay Paul

29-years-old Jay Paul come from Calabar, Cross River state, e describe imsef as "social butterfly".

Im be complete entertainer wey dey run tourism business. Jay Paul dey act, sing and dance as well.

Emmanuel.

Emmanuel

Emmanuel

Im be 24-year-old model wey come from Akwa Ibom State.

Emanuel na model wey dey into pageantry and be winner of Mr Africa.

E dey single and say possibility dey say im go fit "mingle".

Sammie

Sammie

Sammie

Sammie na student wey dey study Guidance & counselling for Ahmadu Bello University, Zaria.

Im come from Kaduna State and plan to enjoy imsef for di show.

Cross

Cross

Cross

31-years old Ikechukwu love clubbing, dancing and girls wey also like to see "women fight over am".

E dey into yoga and plan to bring drama "Wey concern boys and girls fight".



Post a Comment

0 Comments